img_20161026_195252

EPISODE 8 ‘’ 10 STUPID QUESTIONS PEOPLE ASK

.
1. You see identical twins, you still dey ask ‘na
twins be dis’?
No bros, na picmix…lol
2. Nepa brings light and everyone in the
neighborhood shouts ‘up Nepaaa’! My guy ask
me, O boy na light be that?
No oh, Na Holy Ghost fire! Lol!
3. You see person dey vomit, you still dey ask am
‘you no well’? Em well, e just dey practice how to
vomit make he for do freedom.
4. You just wake up from sleep; person come ask
you “you don wake?” No oh, I come buy bread
wey I go chop for dream.
5. You see woman wey born new pikin; u come
ask her “madam u don
born? ” No ohhhh, she buy am for OLX…
6. You greet person “good morning ma” ! She ask,
my pikin you don
wake????
No ohhhh, I dey sleep walk… .
7. My guy ask me “O boy where u dey?” I tell am
say i dey bank, nd him ask me “Wat is happening
there?”
No Nah new yam festival.. *LMAO*
8. My neighbour sees me opening the gates to
drive out and asks me, U dey comot? Not at all…
I
be the new gateman…
9. I dey watch film… my guy enter come ask me
“Guy na film u dey
watch? No naa… I dey discuss with Osuofia…
10.U see me dey chop indomie come dey ask me,
O boy, na indomie u dey chop so? No ohhhh. Na
fried rubber band mixed with thread.
As it stands now, abeg l need to ask u one
question, no vex abeg.
Shey na for Facebook you dey read dis
message??

Spread the love, Please share

Leave a Reply

I.G Telegram NG USA Twitter